Published 6 months ago in Afropop & Afrofusion, in album: Yabasi

Pepper Soup

  • 9
  • 0
  • 0
  • 0
  • 0
  • 0

Yabasi is the official Soundtrack album of the web-series "Papa Benji" by Basketmouth. It was released on 19 November 2020 under Nigerian indigenous record label Freeme Music.

Lyrics

Basket
Faji dog still dey chop shit
But na goat teeth con dey rotten
Select rice comot am from your beans oh
Because rice and beans e no be pepper soup
Select rice out from your beans
Select
Dem no dey stand dey give woman bele oh
No be chice
Unless you want am make she born
But if you don't understand wetin I talk oh oh
Biko we unmawa pa guy you call lgwe light
When NEPA cut big man light
Him go call Fashola Fashola
When NEPA cut that light that a boy light
For night him go fix am back fix am back
If you see fowl wey dey bubble for night iyo
That fowl him no pay him dues
When life come dey show me pepper brother
I carry the pepper do pepper soup
So when life show you shege show you pepper my brother
Carry your pepper do your pepper soup
See goat no dey chop dog food
Dog dey like to dey chop goat
Anytime wey you dey come through
Dem go dey begin dey talk joke
Your matter dey for everybody mouth
My brother tell me whatsup though
You go dey waka dey carry shoulder
Shebi abi you be Jon Snow
Nobody holy pass
If your neighbor dey cut grass
Omo e mean say na the time for you to go carry your own cutlass
At least no dey carry last
Life no be waka pass
My brother some snakes are greener than guava juice wey dey for glass
Open your eye open your eye
When life come dey show me pepper brother
I carry the pepper do pepper soup
Life show me shege show me shege do me something
I carry the pepper do pepper soup
As you bite me for head you no mind my hair
Na so I go bite you for yansh I no go mind your shit
Person wey dey shit no dey smile oh
Oweroye na yo chi na chi
I don go school come out no money
I follow akaraka of a high degree
Faculty of AD and DD
I no do assignment but practical na hit

::
/ ::

Queue

Clear